Skip links

Canada new immigration policy for international students, foreign workers and dia spouses

Canadian goment don set new conditions for international students, foreign workers and dia spouses to cut down di rate of work permit to 35% in 2024, wit di plan to issue 485,000 new study permit.

Di goment say di new target go reduce by 10% for 2025 and 2026, wit plan to issue 437,000 study permit in 2025.

In di latest announcement wey dey inside one statement, Canadian goment put in place new limit on study and work permit for spouses of both foreign workers and students wey dey undergo master’s and doctorate degree programs:

  • Further reduction in di intake cap on international student study permits for 2025 based on 10% reduction from di 2024 target of 485,000 new study permits issue, and den stabilizing di intake cap for 2026 so di number of study permit issue go remain di same as 2025
  • Updating di Post-Graduation Work Permit Program from fall dis year to better align wit immigration goals and labour market need.
  • Limit work permit eligibility, dis year, to spouses of master’s degree students to only pipo wey go spend 16 months duration in dia program.
  • Limit work permit eligibility, dis year to spouses of foreign workers in management or professional occupations or sectors wit labour shortages—unda Canada work permit programs (TFWP and IMP).

Leave a comment